As E Dey Hot Ball

As E Dey Hot Ball As E Dey Hot Ball πŸ”₯
Real football gist, hot takes & match reaction in Pidgin
No filter. No long talk. Just ball.

The xi eleven of men wey sabi, legends of the game demπŸ₯΅πŸ’―Old but not tired, them still dey ball like youngsters ⚽πŸ”₯
05/06/2026

The xi eleven of men wey sabi, legends of the game demπŸ₯΅πŸ’―

Old but not tired, them still dey ball like youngsters ⚽πŸ”₯

Erling Halaand no even give this low-key bobrisky small chance to make his Agege move at all πŸ˜†πŸ˜‚... He even put 100% masc...
05/06/2026

Erling Halaand no even give this low-key bobrisky small chance to make his Agege move at all πŸ˜†πŸ˜‚...

He even put 100% masculine man, and I know say the guy for collect plenty blows if two of them dey inside one room πŸ˜’πŸ˜‚

Agege don see superstar πŸ˜†

No forget to follow us as we go dey give you sharp sharp ogbonge football gist,confam update, legit news and analysis πŸ’―πŸ€ž

Ghana black Stars no be only to dress well and snap pictures oo, make una no play rubbish as usual πŸ€­πŸ˜†.. Imagine 7 games ...
04/06/2026

Ghana black Stars no be only to dress well and snap pictures oo, make una no play rubbish as usual πŸ€­πŸ˜†..

Imagine 7 games without a win, una no get legs??, make we dey watch una shaa πŸ˜’πŸ˜†

Everything wey happen this season no be small cruise πŸ˜‚πŸΏArsenal dog dey celebrate EPL while Bruno dey celebrate Player of...
04/06/2026

Everything wey happen this season no be small cruise πŸ˜‚πŸΏ

Arsenal dog dey celebrate EPL while Bruno dey celebrate Player of the Season. πŸ˜­πŸ†

Chelsea no go smell any European football next season. 🚫✈️

Max Dowman don become the youngest player wey lose Champions League final. πŸ’”πŸ˜­

Carrick take over Man United when dem dey 1️⃣6️⃣ position, while Chelsea dey sit down for 1️⃣st position.

Season come end, Man United finish 3️⃣rd, Chelsea come land 1️⃣0️⃣th. πŸ˜­πŸ˜‚

Gabriel miss penalty wey for fit save dem from missing Champions League glory after all the funding. πŸ’”πŸ₯Ά

This season na one kain season wey no fit ever comot for football history books. πŸ˜‚πŸΏ

Follow As E Dey Hot Ball for more ogbonge update, football gist, analysis and legit updates πŸ”₯ πŸ₯΅ πŸ’―

Real Madrid own na to dey use style to kolombi  players in a low key, them go just promise you plenty things for back th...
04/06/2026

Real Madrid own na to dey use style to kolombi players in a low key, them go just promise you plenty things for back then leave for small time 🀣...

Na you go just use your hand go sign for them for free, and your club go come loose money wey them suppose get from your head πŸ€”πŸ˜«πŸ€£

But my question be say, this wey them dey do, e good? No be juju be that 🀭... E sure say no be curxs wey some club don curxs them dey affect them like this? πŸ€”πŸ€£

Wuckedi club πŸ˜‚

If you don dey watch football games when these guys dey ball, na em be say you sef don tey for this football life oo πŸ˜‚πŸ˜‚D...
03/06/2026

If you don dey watch football games when these guys dey ball, na em be say you sef don tey for this football life oo πŸ˜‚πŸ˜‚

Drop their names for comment section if you no be pikin for this game πŸ€­πŸ˜‚

And no be Arsenal fans dey buy am oo, na Chelsea and Man United fans dey rush am like hot cake πŸ˜‚πŸ˜‚Football fans sef πŸ˜‚πŸ˜‚
03/06/2026

And no be Arsenal fans dey buy am oo, na Chelsea and Man United fans dey rush am like hot cake πŸ˜‚πŸ˜‚

Football fans sef πŸ˜‚πŸ˜‚

This boy think say Chelsea dey follow players play oo, na crazy tattoos you dey focus on instead of to scores goals for ...
03/06/2026

This boy think say Chelsea dey follow players play oo, na crazy tattoos you dey focus on instead of to scores goals for the blues.. πŸ˜‚πŸ€”

Them just dey watch Gernacho shaa, if he no deliver next season ehh, he no go even know the name of club where them go carry am go keep for loan πŸ˜‚πŸ˜‚.... Make he dey zuzu.

If Chelsea really wan compete with menh dem next season, they suppose do everything to keep Cucurrella... βœοΈπŸ€”This guy na...
02/06/2026

If Chelsea really wan compete with menh dem next season, they suppose do everything to keep Cucurrella... βœοΈπŸ€”

This guy na player wey dey play with all em body and life, he dey run like say em life depend on it, Cucurrella na agba baller πŸ’―βš½

Chelsea fans wetin you think about this rumor?? Say your mind for comment section πŸ€—

Make I no lie, this Chelsea new home kit no fine πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€­.. Abi na camera? How una see am πŸ˜‚     #
02/06/2026

Make I no lie, this Chelsea new home kit no fine πŸ˜‚πŸ˜‚πŸ€­..

Abi na camera? How una see am πŸ˜‚

#

Address

Lagos

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when As E Dey Hot Ball posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share