15/09/2022
Manchester United keeper, David De Gea don come outside dey confess say; before I finally join Manchester United, na small thing remain I don nearly use frustration take join Wigan Athletic. Na for 2009 when I still dey Atletico Madrid wey frustration wan kee me because back then na me be third choice keeper so I no even get work. Many times I no dey even see jersey for training talk less of to see jersey for match and the thing dey pepper me because my fear na make I no go get wasted career. So I just dey pray if any club just come ask to marry me, I go behave like church girl wey forget all her home training run follow man and I go jakpa leave Atletico run go join the club. So when Wigan wey dey EPL then begin ask of me, immediately I begin pack my bags and baggages like woman wey don taya to stay her husband house. But na then naim Atletico Madrid come begin play me for match o. Just like that, if I no start, I go dey for bench and that 2009/10 season, I play 35 matches for Atletico even win Europa League join. By the next season I don become first choice for Atletico just like dat sotay the next time wey Wigan come ask for my hand in marriage I tell dem say I am married to Jesus so make dem leave me alone make I face my career. Na dat first choice I be for Atletico until Sir Alex Ferguson pay bride price of 19 million pounds take marry me comot from Atletico straight to Old Trafford. Na God say make I no join Wigan then o, because since I join United I don play 494 matches and win plenty EPL, FA Cup, Europa League, League Cup and golden gloves. Meanwhile Wigan don go relegation since 2013 and till today, preeq wey fall since 2013 never rise up again. Yeye club wey wan carry me dey go where I nor know. Anyway my people make una help me praise the Lord say I no waka da nonsense waka da year.
My people una don hear De Gea own side of the story. Wetin una get to yan inside dis matter?