pidginpunditO

pidginpunditO "Na person wey dey discuss football and other sports matter, dey break am down, and dey give commentary for Pidgin English make everybody fit understand."

🚨🌎 OFFICIAL: Switzerland don carry first position for Group B, and Canada don qualify too for World Cup Round of 32! πŸ‡¨πŸ‡­πŸ†...
24/06/2026

🚨🌎 OFFICIAL: Switzerland don carry first position for Group B, and Canada don qualify too for World Cup Round of 32! πŸ‡¨πŸ‡­πŸ†πŸ‡¨πŸ‡¦βœˆοΈ
Both teams don secure their place for the knockout stage as dem move enter the next round of the tournament. πŸ”₯⚽️

Also Qatar don comot for the world Cup as a result for games wey happen this evening for group B.

πŸ‡¦πŸ‡· Messi πŸ†š πŸ‡«πŸ‡· MbappΓ©Who you think go end di tournament as di player wey get di highest number of World Cup goals? πŸ€”πŸ”₯Na M...
23/06/2026

πŸ‡¦πŸ‡· Messi πŸ†š πŸ‡«πŸ‡· MbappΓ©
Who you think go end di tournament as di player wey get di highest number of World Cup goals? πŸ€”πŸ”₯
Na Messi go hold di record, or MbappΓ© go overtake am?
Drop your prediction! πŸ‘‡πŸ½βš½πŸ”₯

πŸš¨πŸ‡¦πŸ‡· Argentina don beat Austria as Messi make history β€” and dem don qualify for Round of 32! πŸŒŽβœˆοΈπŸŒŽπŸ‡¦πŸ‡· Lionel Messi don beco...
23/06/2026

πŸš¨πŸ‡¦πŸ‡· Argentina don beat Austria as Messi make history β€” and dem don qualify for Round of 32! 🌎✈️

πŸŒŽπŸ‡¦πŸ‡· Lionel Messi don become the highest goalscorer ever for World Cup history, and e don contribute 17 goals/assists (G/A) for him last 10 World Cup matches. πŸ”₯🐐
2026 πŸ‡¦πŸ‡Ή Austria: ⚽️
πŸ‡©πŸ‡Ώ Algeria: ⚽️⚽️⚽️
πŸ† 2022 πŸ‡«πŸ‡· France: ⚽️⚽️
πŸ‡­πŸ‡· Croatia: βš½οΈπŸ…°οΈ
πŸ‡³πŸ‡± Netherlands: πŸ…°οΈβš½οΈ
πŸ‡¦πŸ‡Ί Australia: ⚽️
πŸ‡΅πŸ‡± Poland: ❌
πŸ‡²πŸ‡½ Mexico: βš½οΈπŸ…°οΈ
πŸ‡ΈπŸ‡¦ Saudi Arabia: ⚽️
2018 πŸ‡«πŸ‡· France: πŸ…°οΈπŸ…°οΈ
πŸ‡³πŸ‡¬ Nigeria: ⚽️
🐐 Messi dey always show class for World Cup stage! πŸ‡¦πŸ‡·βœ¨πŸ”₯

Exactly 20 years ago, June 16, 2006, Leo Messi score him first World Cup goal as the youngest player ever to do am for A...
17/06/2026

Exactly 20 years ago, June 16, 2006, Leo Messi score him first World Cup goal as the youngest player ever to do am for Argentina. πŸ‡¦πŸ‡·βš½
Exactly 20 years later, June 16, 2026, Leo Messi don become the highest goalscorer in World Cup history and the oldest player ever to score for Argentina. 🐐✨
Na only am fit write this kind story. It had to be HIM! πŸ‡¦πŸ‡·πŸ”₯

πŸš¨πŸ‡ΉπŸ‡³ Tunisia don sack dia head coach, Sabri Lamouchi, after dem chop serious 5-1 beating from Sweden for dia first World ...
15/06/2026

πŸš¨πŸ‡ΉπŸ‡³ Tunisia don sack dia head coach, Sabri Lamouchi, after dem chop serious 5-1 beating from Sweden for dia first World Cup match! ❌😳
Na only di third time for World Cup history wey one country sack dia coach in the middle of di tournament. 🀯πŸ”₯

Na our today match prediction be disCongratulations to people wey play yesterday ownπŸ™ŒπŸ™ŒπŸ™ŒGood luck for today match
13/06/2026

Na our today match prediction be dis
Congratulations to people wey play yesterday ownπŸ™ŒπŸ™ŒπŸ™Œ

Good luck for today match

πŸΏπŸ‡ΊπŸ‡Έ USA don win their first World Cup match against Paraguay! πŸ”₯⚽Who be your Man of the Match? πŸ€”πŸ†
13/06/2026

πŸΏπŸ‡ΊπŸ‡Έ USA don win their first World Cup match against Paraguay! πŸ”₯⚽
Who be your Man of the Match? πŸ€”πŸ†

🌎 Canada and Bosnia don share points for dia opening match of world Cup.⚽ Na who be your Man of the Match for this match...
13/06/2026

🌎 Canada and Bosnia don share points for dia opening match of world Cup.
⚽ Na who be your Man of the Match for this match? πŸ€”πŸ”₯
And for people wey play our prediction for dia match Congratulations πŸ‘ πŸ‘

🚨 Bernardo Silva don join Real Madrid, HERE WE GO! βšͺπŸ”₯Agreement don complete and contract don approve.Na 2-year deal plus...
12/06/2026

🚨 Bernardo Silva don join Real Madrid, HERE WE GO! βšͺπŸ”₯
Agreement don complete and contract don approve.
Na 2-year deal plus 1-year option. Real Madrid move sharp-sharp, dem start talks just 36 hours ago and dem quickly seal the deal.
Mourinho bin really want Bernardo, and the player don agree. The advanced talks wey come out today na 100% confirmed.

Him been don promise barca say make dem give am time make world Cup finish him go sign for them, but we all know how Madrid mata dey always be... just one phone call baba don change mind.. we wish well sha

12/06/2026

Our prediction for today match
Congratulations to people wey win yesterday
Good luck for today match

Address

30 Tunis Street Wuse Zone 6 Abuja
Wuse
900286

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when pidginpunditO posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Shortcuts

Share

Category