Football in Pidgin Taunt

Football in Pidgin Taunt This page is strictly for football lovers across the globe for memes, taunt, banters against teams.

As e don dey official say we don qualify for African 2026 FIFA Worldcup qualifier Play-off make una get ready because we...
15/10/2025

As e don dey official say we don qualify for African 2026 FIFA Worldcup qualifier Play-off make una get ready because we don move from Mathematics to further Mathematics..

• We go dey four teams wey go play di African play-off and di teams na Nigeria, Gabon, Cameroon and Burkina Faso or DR Congo and di play-off go shele next month for Morocco..

• Any team wey win di African play-off go come qualify for another play-off wey dem dey call “ six team intercontinental play-off” .

• Dem go play di intercontinental play-off in Mexico and e go start next year March..

• Teams wey we go meet their na 🇧🇴 Bolivia, New Caledonia 🇳🇨 , two teams from Central America and one from Asia.

• Inside that Intercontinental play-off, e get wetin dem dey call Seeded teams and unseeded teams( Seeded teams na higher ranked teams in FIFA world ranking while Unseeded na lower ranked teams).

• So dem go divide two 6 teams into two groups, 3 teams per group ( 2 unseeded teams go play semi final anyone wey win go meet seeded team for final).

So di two teams wey win their group go qualify for 2026 FIFA World Cup..

FT Scores: Nigeria 4 - 0 Benin Republic I dey very happy today because my boys show why dem dey call us Super Eagles…We ...
14/10/2025

FT Scores: Nigeria 4 - 0 Benin Republic

I dey very happy today because my boys show why dem dey call us Super Eagles…

We teach Benin Republic lesson and I no go p!ty dem because I warn dem before di match..

As it stands, di 4th goal help us qualify for playoff because of Eritera wey commot for di qualifiers..

Unless say CAF change di rules later sha, so make we see as e dey go..

Eric Chelle abeg na , I know say this match na must win match but e no mean say you go carry 2026 Worldcup materials com...
14/10/2025

Eric Chelle abeg na , I know say this match na must win match but e no mean say you go carry 2026 Worldcup materials come dey play small Benin na..

This one na attacking football Eric Chelle carry come oo, if we don score our 3 goals for first half e go come play defensive game for second half..

I talk am say tactics too plenty for Eric Chelle hand, if Benin Know wetin good for dem make dem no come outside play this match oo..

Eric Chelle even start Adam and Eve for front, na today we go commot Benin for Garden of 2026 Worldcup .

Hehe hehe today na today, my people how una see this formation?

Photo credit: Eagles Trackers..

Follow Pidgin Taunts for di live updates.

Match day!!!! 🇳🇬 Nigeria vs Benin Republic 🇧🇯 📅 Tuesday, 14 October 2025⏰ 5pm Naija time🏟️ God’s will Akpabio Stadium, U...
14/10/2025

Match day!!!!

🇳🇬 Nigeria vs Benin Republic 🇧🇯

📅 Tuesday, 14 October 2025

⏰ 5pm Naija time

🏟️ God’s will Akpabio Stadium, UY

🏆 2026 Worldcup qualifier

For my coach to follow players run cones suppose put fEar for Benin Republic bodi..

If Benin like make dem gym or train for 5hours Eric Chelle go pull up with tactics wey go bUrst their plans.

Na today Benin go regret why dem leave farming enter football because na three different tactics wey go use today..

As we dey cook Benin, Rwanda go help me hold South Africa draw..

I feel like crying for Benin Republic sha because today match go be dem like film..

My people how many you think say Benin go chop today?

If Benin Republic see this picture finish come still gree play match tomorrow anything wey dem see make dem take am like...
13/10/2025

If Benin Republic see this picture finish come still gree play match tomorrow anything wey dem see make dem take am like that..

If you see Eric Chelle you go think say na drills e dey do but you no go know say e dey dance in tactics..

Na three different tactics we go use tomorrow and I just feel like crying for Benin Republic!!!!!!

Children nowadays can choose their haircuts freely while in our time our father just told the barber that let it MBUEMO😂...
12/10/2025

Children nowadays can choose their haircuts freely while in our time our father just told the barber that let it MBUEMO😂

The Barber 👇

E Reach Manchester United turn Liverpool dey HOME🤦🤷‍♂️😂😂👇🏿
11/10/2025

E Reach Manchester United turn Liverpool dey HOME🤦🤷‍♂️😂😂👇🏿

E get where e go reach on Tuesday we go allow Benin Republic win us so that South Africa no go qualify..Once we see say ...
11/10/2025

E get where e go reach on Tuesday we go allow Benin Republic win us so that South Africa no go qualify..

Once we see say South Africa don dey win Rwanda we go allow Benin Republic win us.

I be w!cked man yes!!!!!!

Abeg, if you sabi do jAzz or you sabi pray we go need una help on Tuesday..• If you sabi do jAzz you go help us cook di ...
11/10/2025

Abeg, if you sabi do jAzz or you sabi pray we go need una help on Tuesday..

• If you sabi do jAzz you go help us cook di one wey go make Rwanda win South Africa on Tuesday..

• If you sabi hold rain wella you go help us hold di match make dem play draw..

• If you sabi pray you go help us pray make Nigeria win Benin Republic 3-0.

• If you sabi do ev!l you go help us do make CAF disqualify some teams make we fit qualify..

If none no work una don fall my hand for this kwantri..

10/10/2025

Omo this Benin boys no gree, wetin dem wan find for world cup sef ? 😏😆

FT Scores: Lesotho 1 - 2 Nigeria My people we don go  South Africa win Lesotho collect three points join..I dey very hap...
10/10/2025

FT Scores: Lesotho 1 - 2 Nigeria

My people we don go South Africa win Lesotho collect three points join..

I dey very happy because South Africa play draw and I dey vex small say Benin win today..

Di best thing na to win Benin with more than 3 goals for last game then South Africa go come play draw!!!

Make una trust di process, we go play 2026 Worldcup..

Address

No, 10 Ekiti Avenue, Ijapo Estate, Akure
Ondo
351101

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Football in Pidgin Taunt posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share

Category