Mokwa Football Association - M.F.A

Mokwa Football Association - M.F.A To discause the issues on how and what is going oon in our football clubs

♥️♥️❤️
04/05/2024

♥️♥️❤️

08/04/2024
First Nupe FIFA Referee With Ahmed Musa MON 💞💞❤️💪Our ownProud of you guys🇳🇬🇳🇬🌹🌹
26/02/2024

First Nupe FIFA Referee With Ahmed Musa MON 💞💞❤️💪

Our own
Proud of you guys🇳🇬🇳🇬🌹🌹

E Be Like Say Mokwa Referees And FA Wants All The Round 16 DRAW O!😳That's Why Dem Dey Award Unnecessary Goals And Penalt...
18/11/2023

E Be Like Say Mokwa Referees And FA Wants All The Round 16 DRAW O!😳

That's Why Dem Dey Award Unnecessary Goals And Penalties. I No Blame Nasara a.k.a Anger FC Again O!

Yesterday Referee Don Cancel Sweet, Clean Goal Wey Gbajibo Fc Go Take Lead Muwo United 2-0 To Make Comfortable Like Bayern Munich.

Wetin Vex Me Pass Na That Same Goal Wey Ref Cancel For Gbajibo Fc Na The Same Goal Infact That Muwo Own Worst Pass That Gbajibo, Na Im That Same Referee Award For Muwo United. That Same Referee O!

Well The Match End 1-1, Dem play Penalty And Muwo United Don Qualify To Next Round. Gbajibo Fc Don Pack Their Ƙaya Comot From This Tournament, Dem Really Fought Well. If No Be Ref, Na Dem Go Qualify.

My People, Do You Really Like Wetin Mokwa Referees Dey Do? Remember If Na Indigen Team Dem Kídnap Yesterday Fî8ht No Go Come?

Defeat This Evening Abi How Chelsea Admin Dey Take Tok aym Then.🤦🤦FT Scores: United Boys 2 - 1 GbastefMy Peoples Gbastef...
14/11/2023

Defeat This Evening Abi How Chelsea Admin Dey Take Tok aym Then.🤦🤦

FT Scores: United Boys 2 - 1 Gbastef

My Peoples Gbastef Comot For Engr Bawa Tournament After United Boys Knack Dem Red, Black And Blue And Wetin Vex Me Be Say United Boys Carry Gbastef Reach 90th Plus Jara Minute Before Dem Score The winning Goal.🤦

As I Dey Talk To You, Gbastef Is Go, Going, Goes And Gone 😥😥

Chai, Make I Go Rest For Chamber 🤦

FT Scores: Ultimate FC 0 - 1 Nasara Fc.My people, Nasara Fc don surprise us this evening even people like us wey don pla...
05/11/2023

FT Scores: Ultimate FC 0 - 1 Nasara Fc.

My people, Nasara Fc don surprise us this evening even people like us wey don plan how we go take laugh Nasara fans this evening but wetin we carry for mind no be wetin later happen.🙆🙆

Ultimate FC wey score 6 goals in their first game no fit score 1 goal in their last two match.

Stubborn Gbastef join Nasara Fc Qualify for round 16, na that one sh0ck me pass

As it stands, Ultimate FC don pack their Ƙaya Comot from this Tournament because dem lose to 10 man Nasara today.

My people i know sure whether I fit sleep well this night wey Nasara Fc win match because their fans go soon start dey worry me with "we told you".😒

Una goodnight, football no go matter for heaven.

05/11/2023
Defeat this evening abi how Chelsea admin dey take tok am.🤦🤦FT Scores: Ebo Soko 0 - 1 Gbajibo FcMy people Ebo Soko don g...
31/10/2023

Defeat this evening abi how Chelsea admin dey take tok am.🤦🤦

FT Scores: Ebo Soko 0 - 1 Gbajibo Fc

My people Ebo Soko don get only 1 point for Engr Bawa Tournament after Gbajibo Fc knack dem black and blue and wetin vex me be say Gbajibo Fc no allow Ebo Soko score goal.🤦

As i dey talk Ebo Soko don dey down down for table like Sheffield United if English Premier League.

Gbajibo Fc no follow Tatabu United waste their Okada money come mokwa today 🙁

My people shey Gbajibo Fc fit qualify for the next round? Dia next match na with Maza Fc 🌚

Chai, make I go sleep.🤦

📸 Joon DaJoon DareJoon Dare

FT Scores: Maza Fc 3 - 0 Tatabu United.Maza don start again this Tournament oo! I hope say una no go prank us as una tak...
31/10/2023

FT Scores: Maza Fc 3 - 0 Tatabu United.

Maza don start again this Tournament oo! I hope say una no go prank us as una take prank us last season against Ebo Soko in Modiya Micro-Finance Bank Cup wey happen on this day of last year.

Make we sit-down watch whether Maza Fc na Cup contenders abi na Cup pretenders.

Abeg make we appreciate Maza Fc dem try.

📸 JJoon DareDJoon Dare

Football dey unpredictable.😄Muwo United don use their normal juju knack Power Line Fc 2-1 for Engr Bawa Tournament for M...
30/10/2023

Football dey unpredictable.😄

Muwo United don use their normal juju knack Power Line Fc 2-1 for Engr Bawa Tournament for Mokwa today but still na penalty Power Line Fc use equalize, come still Man Utd the match. 🙆

Everybody think say Power Line Fc go win oo till Muwo United come dey play like Man City, Power Line e come dey down down with Young Groovers till dem discover Crude Oil with 1, 1, point.🙆

Muwo United and Muwo Success no waste their Okada money come Mokwa today, all of dem dey shine teeth like Ronaldinho🤔

Today na happy day for Muwo people 🤗

📸 Joor Dare

FT Scores: Muwo Success  2 - 1 Young GrooversMy people, Muwo Success don carry Keke enter Mokwa knack Young Groovers 2-1...
30/10/2023

FT Scores: Muwo Success 2 - 1 Young Groovers

My people, Muwo Success don carry Keke enter Mokwa knack Young Groovers 2-1 still collect three points join.🙆🙆

Muwo Success just use Young Groovers play for their second match today and the one wey vex me pass be Muwo Success coach talk say if no be penalty, Young Groovers no fit score one goal even if na second hand goal. Dem no fit score. 😄

As it stands, Young Groovers don jump back to 4th for table and the way Young Groovers dey come down if dem no dey careful dem fit follow FC Santos dey drAg Chairman's Cup next season.

📸 dare

Address

Mokwa

Telephone

+2348121455465

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Mokwa Football Association - M.F.A posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share