14/05/2026
We don dey hear now say Arsenal winger, Leandro Trossard don break up with him wife, Laura Hilven after 13 years and 3 children together. While we no know wetin cause their break up, some people dey suspect say the woman dey vex say Trossard love Arsenal pass her because every day and every night him dey with Arsenal wey make she and her children dey feel like abandoned property. Dem say him wife don ask am taya to choose between her or Arsenal but since him no gree choose she don kuku help am choose. So as e be now, Trossard wife don remove herself from the picture so that she no go be distraction again o. Some Arsenal fans sef dey suspect say e be like na opposition fans send Trossard wife to come cause problem so that him go lose focus make Arsenal for lose the league, the same way APC send somebody go cause problem for ADC make dem for lose the election.
My people make una join me wish Trossard all the best for this difficult time.