03/09/2026
π¨β€οΈ Zinchenko talk about him and Gabriel Jesus time for Arsenal:
π£οΈ βToday, I call Gabriel Jesus and tell am say make we give Arsenal their flowers. When Manchester City no really give us chance, na Arsenal open door for us and give us place we fit call home. Mikel Arteta call us and tell us say e dey ready to welcome us for Emirates.
For Man City, our positions don already get players, so na bench we dey warm almost every game. E no easy at all. But because we get good relationship with Mikel Arteta from when e be assistant coach for City, we tell ourselves say Arsenal na where we wan go.
I don leave Arsenal and Jesus too don move go Barcelona, but the love wey Arsenal show us no be something wey go just disappear.
I no leave Arsenal as Premier League champion, but I believe say I help build the foundation. Jesus don become champion with Arsenal and e really deserve am.
We just dey wish Arsenal all the best. Arsenal go forever remain our home. β€οΈπ€β
Wetin be una think about wetin Zinchenko talk ??