10/01/2014
DIS WORLD SEF
• U collect babe number u use "chick"
store em. Shey en mama na fowl? :>
• U buy suya ur woman chop all the meat
finish u con dey smile dey chop the onion,
u be vegetarian?/ • U dey wit ur guy & u
dey recieve diff kinds of phone calls every 5
min, yet u dey claim say u no dey cheat on
ur guy. My sista, u be MTN customer care
agent?
• U ask a girl for what she wants, she tells
you money and you are angry. Were you
expecting her to say wisdom &
understanding?!
• U dey carry ur girlfriend go club, after U̶̲̥̅̊
marry her finish U̶̲̥̅̊ want stop her frm goin
to club. My broda U̶̲̥̅̊ think say miracle fit
happen? :x
• Ur mates pay complete fare, sit down
comfortably 4 bus, u pay half dey stand n
smile. Bros u b usher? • Ur gafrnd dumps u
for a rich man u say she b golddiga bt ur
sister do d same to anoda guy, u giv
testimony for Church, sey na grace of God.
Bros park well> • Since last 2 weeks, PHCN
never remember ur street n una no get
common Tiger gen, yet u come my house
still dey borrow Jackie Chan film from
me...bros na PHCN office u wan go watch
am?>
• Yo babe get F9 parallel for WAEC, she still
dey ask for Brazilian Hair of #150.000 .
Were she wan fix am?, ontop that coconut
head?
• U have 8 tribal marks, stretch marks
scattered all ova ur body yet u still want a
tattoo...ah! my friend u be zebra • U are 6
feet tall, u still com wear 6 inches high heel
shoe...se u wan whisper to God? | |
• U dey snap inside different type of cars
yet u expect ur man to believe u are not
cheatin..aunty,u be mechanic? :|
• U gather different gals picture for ur fone
& yet u xpect ur gal to believe u are not
cheatin.. uncle, u be photographer?
• He gave u an engagement ring for over
five years, e never marry u, my dear u be
lord of d rings?